09/04/2026
Today make am seven years, five months, three weeks, three days, and twelve hours… since one stubborn goat push me for Life Camp 😭
Omo, I no fit ever forget that experience!
My mama send me make I carry food go give one of our family members wey dey Life Camp—dem dey call the place Army Base side.
As I dey go, jejely minding my business, dey even jolly dey waka… next thing I see, one short goat dey run come my direction.
I think say maybe e dey pursue another goat or something. I no even send am.
Na so, before I know wetin dey happen—BAM! I don find myself for ground! 😭
The goat use him horn push me like say I be ball!
Omo, as I stand up, no be small race! I begin run for my life. I still dey wonder if na dream I dey dream—I even dey tap myself make I wake up 😅
This goat no gree! E pursue me reach person house!
I just run enter—people wey dey outside dey cook, I no even greet. I pass their pot like thief, enter house wey I no know, carry door lock myself inside 😭
The goat come stand for the door like security man… as if e dey wait make I come out.
After some time, e come finally waka go.
Since that day till now… I no go lie—I still dey fear goat 😭😂
Abeg, make I share una this trauma small. How una dey this evening? 😄