28/06/2024
Good day everyone 🤭🤭 to those following us, thank you 🥰, to those scrolling past una well done, I'm seeing you.
Anyway, this is the latest page in town now and we have a small offer to everyone. Read carefully to the end only then, will you know what the offer is. My ladies in town, afar na👊
You dey form slay queen and you never wear crochet outfit, abeg wetin you dey form? Crochet wears wey be latest in town now as we dey talk no dey your wardrobe even the cheapest of them all, scrunchie. Haa my dear, u never slay at all, you no even dey the learners stage, na introduction u still dey do. Better message me now oooo, I repeat message me now. I dey do sales now oooo. Buy a top, get a bucket hat FREE. I repeat, buy a TOP, GET A BUCKET HAT FREE. This promo na to celebrate this brand landing on Facebook 😁😁 shey u get na and the promo no be forever oooo so no time to waste time. The promo na for 5 days, I repeat 5 DAYS, better rush me now oooo, before your competitor in the slay queen business first you buy. Hmmm, e no go funny my dear, u yourself know say e no go funny. Before them pepper you, pepper them first so they go dey regret. Run enter my DM, before you go hear offer don expire, I dey tell you ooo
5 DAYS COUNTDOWN
DAY 5 going going going
E still dey go ooo. If you like, let your neighbor buy before you, your mind go dey that time. Enter my DM now now now