30/09/2021
Make I do sumo tatafo for una dis moreen. E get one hunku for our yard laidat for area where I dey live. Every moreen when you see this hunku, e no dey smile. E go tell you say him no sleep well. Say na so so bad dreams e dey dream for night. We beg am say make e go for deliverance, for where? Na same same. Until yesterday hunku scream run commot for room for broad day light. Na him olofus for yard run come out again. Na wrapper me sef tie as nepa no giffus light. We ask hunku wetin happen. E say na the bad dreams again. Shuo! Wetin dey happen na? Na only you? Hiyyah! Hunku let's enter the room sef and start warfare prayers. So that olofus go get peace.
My pipu, if you see the bedsheet wey hunku dey use sleep! E don retire but hunku no gree liffam. Na him i come tell hunku say no be village pipu dey do am. Na this bedsheet dey giffam bad dreams.
Hunku don buy bedsheet yesterday. He still dey sleep. No worry, when he wake up, I got ask am how e be!
No blame village pipu for your bad dreams. Change that bedsheet wey don retire today and begin to dey enjoy your sleep.
Oya, contact Royal beddings today make we epp you change am.
08052031066